On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Crash: Sanwo-Olu Don Order Say Make Dem Chook Eye For Di Accident

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Sanwo-Olu still send sorry to di family of di pipo wey die for di accident.

Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu don tok say make dem chook eyes wella for di accident wey happen for Ojuelegba on Sunday, wey kill eight pipo.

The PUNCH tok say, na 20ft container truck na im fall from Ojuelegba bridge come fall on top one public bus wey crush di pipo wey dey inside di bus to death, na only one persin wey dey inside di bus na im survive.

Sanwo-Olu wey represent di pipo and government, show say him dey sorry to di family of di pipo wey die for dis bad accident wey happen.

Dem go chook eyes wella for di accident, so dat another bad accident like dis one no go happen again for future. We dey work with Federal Ministry of Works and Housing, so dat dem go fit put motor/trailer blocker for di inside and ouside part of di bridge.

We dey share di pain of di pipo wey lose deir loved ones for dis accident and we dey pray make  Almighty God go give dem power for dis hard time. 

''Di government go continue to put deir Transport Master Plan, wey get safety measures and wey go make sure say our roads go dey safe,'' Sanwo-Olu tok dis one for one announcement wey Commissioner for Transportation, Dr. Frederic Oladeinde arrange give am.

#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C