On Air Now

Kulele Zone

3:15pm - 6:00pm

Buhari Don Carry GCFR, GCON Titles Give Tinubu, Shettima

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

President Muhammadu Buhari don carry national honours give President-elect Bola Tinubu and Kashim Shettima, the vice-president-elect.

Buhari don give Tinubu di title Grad Commander of di Order of di Federal Republic(GCFR) and give Shettima di title Grand Commander of di Order of di Niger(GCON)

Dis one happen for State House Conference Center for Abuja as part of all di events wey go happen go reach di May 29.

Di events wey go happen before di official swearing for May 29 na Inauguration Lecture on Saturday May 27th wey di Former President of Kenya, His Excellency, Uhuru M. Kenyatta go tok put for di topic, 'Deepening Democracy for Integration and Development'. Afta dat one, special children's Day Program wey parade and party go dey.

On Sunday, 28th of May, Inter- denominational Church Service go happen for di National Christian Centre, den Inauguration Dinner/Gala Night go follow later dat day for di State House Conference Centre.

Boss Mustapha wey be di Secretary to di Government of di Federation don confirm say correct security go dey through out dis swearing in period so make dia guests no fear at all.

How una see di mata?
#chookmouth  


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C