On Air Now

You & Yaw

9:00am - 11:00am

2023 Presidential Election: Obi Don Win For Cross River

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Di Labour Party presidential candidate, Peter Obi, don win di presidential election for Cross River State.

Presidential candidate wey dey represent Labour Party (LP)  Peter Obi get 179,917 votes, and him closest rival, wey be Bola Tinubu of the All Progressives Congress (APC)  get 130,520 votes and di Peoples Democratic Party (PDP) candidate,  wey be Atiku Abubakar, na him carry third with 95,425 votes.

How di parties take get votes for Cross River State: 
A 425
AA 221
AAC 406
ADC 2268
APP 885
APC 130520
APGA 618
APM 535
APP 252
BP 414
LP 179917
NNPP 1644
NRM 371
PDP 95425
PRP 822
SDP 290
YPP 422
ZLP 1533

Na di State Collation Officer of Presidential Election wey be Prof Akpofure Rim-Rukeh, na him arrange dis one give INEC and as e dey be so, base on di election results wey dem don gather so far, out of di 18 presidential candidates wey dey run for dis election waka na Obi, Tinubu and Atiku dey lead. 

#chookmouth

 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C