On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

Samuel Eto'o attack pesin outside stadium for inside Qatar

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Shocking video outside Stadium 974 for Doha dey show as Eto'o wey be di current Cameroon FA Presido dey brutalise pesin.

Samuel Eto'o no be new face for football as eim be legend of di game wey don win plenty trophies for Europe and Africa.

During di ongoing FIFA World Cup for Qatar, particularly di match wey Brazil bin kpokpo South Korea 4-1, di scene captured by 'Laopinion' dey show Eto'o as eim dey jejely commot from di stadium.

From nowhere, one man wey dey carry camera come dey near Eto'o and the both of dem start to dey exchange words. Next thing wey happen, Eto'o rush di man, kick am as di man fall down for ground.

Eto'o don come out on twitter come apologise say eim dey sorry for wetin eim do. 

From di statement released, Eto'o don confirm say di man wey eim attack na Algerian fan, say make Algerians stop to dey disturb am and Cameroon fans.

Di whole problem bin start for World Cup play off wey Cameroon defeat Algeria to qualify for di World Cup. Algerians dey claim say Eto'o bin do magumagu despite di fact that FIFA don clear di mata in favour of Cameroon.

 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C