On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

'MEXIT' - The end of an era

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Di end of an era as Lionel Messi don part ways with FC Barcelona

Di La Liga rules wey dem bin introduce for 2013 dey limit player wages and acquisition costs to 70 percent of club revenues.

Dis one mean say e get salary limit wey La Liga clubs no fit pass if you dey consider how much di club dey earn per year.

After corona join spoil financial flow, to meet di requirement sign Messi, FC Barcelona suppose bin reduce total salaries by $200 million. But di club no bin fit and di only option na for Messi to waka commot.

''I want it to be clear that Leo wanted to stay and the Club wanted him to stay. There comes a moment in the negotiations when you have to make a stand and analyse the figures rigorously. I am sad but convinced we have done the best for FC Barcelona's interests''. Joan Laporta - FC Barcelona President at di press conference for Auditori 1899 today morning.

So as di matta take be, Messi dey go separate ways with di club wey him bin spend more than 2 decades.

Di big question now be say, 'Which Club fit accommodate Messi?'


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C