
Former Super Eagles interim head coach, Monday Sinclair, don kpai. Di man die at di age of 88.
Na former Super Eagles goalkeeper, Peterside Idah, wey play under am for Sharks FC, confirm di tori on Wednesday. Peterside tok say di man na like mentor to am.
For Facebook tribute wey he drop, Peterside write:
"Our daddy don go. Wetin man!
Na him sign me make I play for Sharks. Na him give me my first match against Niger Tornadoes of Minna.
Di first day wey he see me come train with Sharks, he ask me, ‘My friend, you be boxer?’
He say I build like Tyson. From dat day, na so I find football papa. I come close to am and im family. Puppa K na like brother to me."
Sinclair play for Green Eagles back for di 1960s, and people sabi am well for di way he dey spot talent and how he contribute big to football for Naija.
He start him coaching journey with di Sharks FC wey no dey again, then coach Niger Tornadoes, Enugu Rangers, and Bayelsa United.
For 1997, dem appoint am as interim coach for Super Eagles. Later, he even coach Equatorial Guinea national team.
Plenty big players for Nigeria, like Peter Rufai, Taribo West, Finidi George, and Peterside Idah, na him mentor dem. E help groom dem from grassroots and him impact still dey show for Nigerian football today.
This kain sad news come just few days after another football legend, Peter Rufai, sef die after long sickness.