On Air Now

You & Yaw

9:00am - 11:00am

Di action don set for UEFA Champions League 2022/2023

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

UCL don return with big Matchday 1 clash between PSG and Juventus

UEFA Champions league dey make a return and football fans go get to see some kind ogbonge games. 

Dinamo Zagreb wey for their history never pass group stage go play for di first time against Chelsea wey win di competition 2 seasons ago. 

Sevilla and Manchester City go jam for inside Group G.Di last time wey dis 2 sides meet, Manchester City bin win both for England and for inside Spain.

Celtic wey no bin fit qualify from group stage di last 3 times dem show face for UCL dey play Real Madrid wey be current title holders.

PSG go play Juventus for Parc des Princes. PSG don lose di last 6 games against Juventus and don draw 2. For dis fixture, di stars and big names dey with PSG but history dey favour Juventus.

On Wednesday, di 7th day of September, Bayern Munich go play Inter Milan for San Siro and for dis competition, Bayern get 100% away record against di Italian side-Inter. Dis group be one of di toughest as Barcelona wey dey on top form with Lewandowski go wan also qualify for di next stage.

Dis season go be di 3rd time in 5 seasons wey Napoli and Liverpool go am for inside group stage with Napoli winning in 2018 and 2020 and keeping clean sheet in the process.

Tottenham wey don appear 6 times for UCL go play Marseille for inside Group D wey don win just once against English team in di last 13 trials.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C