How Councilor Go Collect Big Salary Pass Lecturer! –Sowore

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

The presidential candidate of the African Action Congress, Omoyele Sowore tok say e no make sense say local govament councilor dem, dey collect big salary pass pipo wey dey teach for univasity.

D tin dey do Sowore like feem, say students don too stay tey for houz, more dan 6 months, yet government nova finish talk wey go make students go back school.

"E no fair say local government councilor wey no get degree dey collect fat salary pass our lecturers and we no fit invest money for our university wey go produce the future but wey dey carry money buy SUV for Niger Republic."

 

Sowore siddon with Wazobia FM presenter Expensive for Evening Oyoyo show, take dey release all dis word comot from im mouth. Dem dey tok weda old pipu suppose still dey drag presido chair for we country.

Eim say wen dem do Student Union Goverment work dat year, dem know wetin the position dey about and dem also get people wey stand for dia back like Femi Falana and Gani Fawehinmi. 

 

"The pipu wey dey lead students today, dem dey dream to be like the pipu wey dey do dem anyhow.

"If Govanor dey drive big moto, NANS presido self wan drive big moto like Oga govanor."

The AAC presido flagman still add say as dis NANs Oga dem dey dream to be like thief, dem too na baby thief or thief wey dey learn work.

Anoda angu wey Sowore touch na say if eim become presido, one of the first thing wey eim go do ontop Education mata na to declare state of emergency ontop dat sector.

Cos to Sowore, apart from say im go make Education dey free up to university level, eim go still give students 100 thousand Naira every semester as study grant to take transport dem self.

"I go prefer to invest money on top students than to invest on top senator wey no dey do anything for us."

 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C