Wetin Dem Dey Do For Lagos Na Agbero-cracy - Gbadebo Rhodes-Vivour

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

The Governorship candidate of the Labour Party inside Lagos State, for the 2023 gubernatorial election Gbadebo Rhodes-Vivour, wey many pipu dey call GRV

Waka enta we #ChookMouthStudio to tok about eim plans for the state if the pipu decide say na him we want as Governor. Ontop the siddon tok with the candidate. Eim tok about the mata of agbero and insecurity for inside the state.

According to Gbadebo, eim say if eim become the Governor eim go commot agberos from road, come train dem with skills wey be say dem go use dey feed themselves and dia family. Eim still say after the training dem go tell any contractor wey dey do work for inside the state to employ dem first before any other person.

On top security mata, GRV say eim go arrange state security network wey pipu go fit dey share informate with police so that dem go fit gbab any security gbege wey dey inside the state.

The candidate still share eim plan to make the state infrastructure, education, and urban Planning to dey kajad, and him tok say Lateef Jakande use four years do wetin  All Progressives Congress (APC) neva do for over 20 year wey dem dey power. And for him na the Jakande blueprint for Lagos him go follow and try to do pass.

Safety of our transport system na something wey eim tok say eim no go use play for the state, because him be architect wey sabi how to make sure say accident like the one wey happen inside Lagos, wey train jam Government staff-bus no go be something wey go happen again. 

 Gbadebo also tell members of the state say make dem no fear on Saturday, 18th of March. Make dem come out to come vote and say the party ready  to defend the vote wey people go give dem that day.
 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 23°C