Why Men Dey Fear Successful Women?

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

One Of the focus of United Nations sustainable development goal, na gender equality. The role wey women dey play inside awa society no be small one, both inside for family and for community.

Talking about the role wey women dey play inside family. No be today the United Nations don shout women need to dey empowered because them fit play beta roll to make society beta.

Even Plenty businesses don dey try to ensure say everthing balance dey,  untop how dem dey take employ pipu for dia company. To the extent say some of dem they advertise role wey no get plenty women inside, for more women to come work.

But as more and more women don dey get opportunity, and dem don dey dey successful for the work wey dem dey do. Another challenge don dey show for inside some of dem house. 

This new challenge wey plenty of this women dey face inside their house now, na with dia partners. dia success don dey make dia partners dey fear. The question now na why the pesin wey suppose to be your number one supporter, come be the pesin wey dey bad belle you.

Naim make wey Cheche say she must find out why plenty men, dey fear successful women. why dem want make dia woman dey under dem?

Watch the full video of the program, to know why some men dey fear successful women.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 33°C | Low: 22°C