Why Eim No Dey Like Do Collabo For Now - Victony

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

One of the fastest rising singers inside we obodo naija Anthony Victor, ey plenti people know as Victony, talk about eim new EP project wey eim drop wey the title na the "Outlawz",

The EP #Outlawz be victony second EP project. Eim drop the first one wey eim call #Saturn for 2020 and  the project get  6-tracks wey na only Falz eim feature ontop.

Inside the new project Victony no feature anybody inside, this one come make Cheche ask am why eim no dey like join bodi with pipu for inside eim projects? Victony explain say eim dey try make pipu understand eim sound first before eim go come dey release eim collabo. That na the reason why eim neva dey drop the collabo wey eim don do. 

Eim also talk about why for now eim neva ready to date anybodi, plus how eim parent feel about the fact say eim dey do music.

Watch the video to hear everi everi wey dem tok inside the siddon talk.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C