Oyibo Pipu Dey always Ask Me Wetin Be Nwantintin - Ckay

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Ckay wey be one of the fastest rising star from we obodo naija, wey plenti pipu ontop social media for inside obodo the world dey feel eim jam. Enta we studio top follow CheChe tok about eim song wey dey scatta everi where.

Ckay wey eim real name na, Chukwuka Ekweani. na producer/artiste  wey dey with Chocolate City Music before eim come join Warner Music South Africa. Be one of the hottest artiste inside we obodo naija and even obodo the world.

The artiste release love Nwantiti, as part of eim EP CKay the First, for 30 August 2019. But na untill the lockdown for 2020 na eim the song start to dey blow up as plenti pipu start to dey us am for TikTok . Love Nwantiti na one of the most streamed songs ontop tiktok and other social media platforms with 15 billion streams, and e also dey ontop different billboard charts.

OgaMadamOffice host @Chechesmith Siddon with Ckay to tok to am about how eim feel about everi evri wey dey happen for eim music career now and wetin be eim plan for the future.

Ckay come tok how the attention wey eim music dey get, dey burst eim head, say even when eim travel oyibo pipu wey don hear eim jam and dey feel am sef but dem no know wetin love Nwantiti be dey always ask am wetin be the meaning. And the whole thing come teach am say language no fit stop music to blow, as far as say the music good.

Ckay come even do small amebo for us, make eim fans ready for eim album because eim don dey cook beta gbedu for dem inside the album. And when Chechesmith ask am about the collabos wey dey inside the album. Ckay tok say wetin eim fit tok about the collabo for now na say e get plenti artist inside we obodo africa and even the world sef.

Oya watch the video of the the siddon tok with Ckay.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 33°C | Low: 22°C