On Air Now

Evening Oyoyo

7:00pm - 11:00pm

Naira Marley Tok About Eim New Album And Why Eim Hate interviews Wen Eim Tok To CheChe

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Azeez Adeshina Sanyaolu wey many of una know as ​ Naira Marley, one of Naija most controversial artist, enta we #wazobiafmlagos studio to follow #cheche tok about eim new project wey be God's Time The Best #GTTB.

The siddon talk wey be part of eim first ever media tour wey eim go ever do since eim become one of the biggest artist for obodo naija. Naira tok about why eim no like interview and the inspiration for the title of eim new album God's Time The Best #GTTB.

Cheche wey be the host of #OgaMadamOffice ask am whether that title been don dey eim head since and if eim been get other options for eim mind before? Naira tok say the title of the album na just to tok about wetin dey happen for eim life.

Eim also tok say eim with everi everi wey don happen for eim life, like when eim two babymama get belle the same time and eim been no ready to get pikin that time for eim life.

Dem also ask am about how eim take dey choose the talent wey eim dey work with, and how many acts wey eim get signed under eim label. Naira say before eim go sign any talent eim dey first build strong friendship with the act, so that bound go strong pass just business.

oya watch the full video to see the full siddon tok with the marlian presido  


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 23°C