Husband Dey Collect Him Wife Salary.

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

One man don wey lose him job, don ask him Wife to dey give am her Salary to dey use manage the family, the man go also dey give her money to dey spend from there.

chechesmithnation tok tori ontop OgaMadamOffice of one woman wey her husband ask her to dey bring her salary give am, make him help her dey manage am. The woman gree oh, later she kan decide not to dey give her husband her salary again, the thing cause serious wey her husband almost beat her one day in the process of argument and sotey her Mother-in-law and sis-in-law tok say she no dey submissive because she refuse to continue to give her husband her salary.

E bad if Husband ask eim wife to always bring her salary make him manage am?? #chookmouth for comment section


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 23°C