On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 5:00am

Bella And Sheggz Relationship Dey Annoying - Kess and Pharmsavi

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Saviour Ikin "Pharmsavi" Akpan and Kesiena Tony "Kess" Adjekpovu wey be the latest housemates wey dem commot for inside the Big Brother Naija House. Enta we Wazobia Fm studio to follow us tok about dia waka for the house.

Cheche Smith  for ontop Oga Madam Office show, ask Kess about why eim been no too put body and show eim self for the show if na because eim dey married.

Kess tok say, marriage to be one of the reason wey make am dey laid back when eim dey inside the show. Eim enta the house with the mindset of relax for like two weeks, and eim to come be sporty person at all may be Naim make people feel say eim dey laid back.

Ontop mata of relationship inside the house Cheche come ask am why e be say Phamsavi wetin eim think about all the ships wey dey inside the house. Him yarn say the relationship for the house they make the game no dey interesting, as some housemates if dem don join bodi like that dem ey forget say na game dem dey inside.

Kess still yarn put for the mata say, if eim get the power because of  the relationship between Bella and sheggz inside the house eim go commot dia two because dem no dey makes the game sweet with the close making wey dia two dey do.

Oya watch the full video of the siddon tok

 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 32°C | Low: 22°C