On Air Now

Area Mata

Noon - 3:00pm

Tonye Cole Tok About Wetin Eim Go Do Pipu Wey Dey Run Illegal Refinery

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Just wen e be like say the dream of governorship for Rivers State wan end for Tonye Patrick Cole, because of the judgement wey federal high court give on top the governorship ticket wey Tonye win for the All Progressives Congress (APC) primary for Rivers state.

The court of appeal come tell Tonye say make eim cool eim temper as dem cancel wetin federal high court tok for the mata.  Dem come tell Tonye make eim continue eim hustle to be governor.

The former executive director of Sahara Group, enta we chook mouth studio to follow Chiboi tok inside Kulele Zone about him waka for the election dey go and wetin be eim plan if eim become governor for inside Rivers State.

Cole chook mouth ontop on of the mata wey dem take dey hold eim cloth for inside court, wey be say eim get both Britain kpali and Naija own. Eim tok say "everi body know say i be Naija Pikin, Even though God don bless me to fit waka go outside Naija. Everi thing I get today Na Nigeria gimme even up to the school wey i go and the business wey i get. So Nigeria dey my blood. "  

Ontop the mata eim still say e no mata where pipu dey for inside obodo the world as Naija pipu, dia "Naijaness" must first be number one thing, and dem go need to do dia part to make Naija beta.

Chiboi ask Oga Cole about wetin eim plan be to stop the badness of illegal refinery wey don make some part of the state turn black. Eim yarn say " Oil bunkering na big problem for River state, and i know say na poverty, lack of education and lack of opportunity naim dey make the mata bad as e be. Even though say the illegal waka they help pipu survive but dem need to know  say the waka dey cause kasala for the area and for well bodi. So for me na to Siddon with dem and show dem say another way dey wey dem fit take make that money dey, no be only like dis." 

Eim still yarn say 2023 governorship election go dey carry anoda leg. As pipu wey no dey like vote before because na the same pipu dey join bodi for the election. Dem wey vote for this election because eim dey chook bodi for the election and dem believe say BVAS go make dia vote count.

Tonye tell Rivers pipu say the state get wetin e take to be like country inside  country, with beta opportunity and plenti moni. But dem go need dia PVC to take make that eim dream for Rivers state happen.
 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 22°C