On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 5:00am

Tinubu/Shettima Team Tell Us Wetin Dey Dia Manifesto And Dia Plan To Make Am Work

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

We get 112 days to the Nigerian general election and many political parties don they drop wetin dia plan be to move Naija pipu from the hard place wey dem dey go beta place.

The All Progressives Congress presidential candidate, Bola Ahmed Tinubu and eim running mate Kashim Shettima Mustapha don also drop dia manifesto, and to help Naija pipu understate wetin dey inside am, members of dia campaign team don dey waka and down to help Naija pipu see wetin dem don plan to do when dem win the election.

One member of the Tinubu/Shettima campaign team, Ifeanyi Ajuluchukwu siddon with one of our tok tok person for #OurBackyardShow, Tombo Belle. To tell listeners about dia 80 page manifesto wey dem don arrange and how dem go take do everi thing wey dem write if dem win.

Ajuluchukwu yarn say dia plan na to build Nigeria wey everibodi go feel dey dem follow inside, young pipu go get work and life go beta for everibodi. And no want make we just dey import everi thing, just like we dey export our entertainment to the work, we fit also dey make our food and export to the world self.

Eim also tok about wetin dia plan be for young people, money wey pipu dey make for dia work, infrastructure, The fear of Agbero and corruption fight.

Oya watch to see everi-everi wey eim get to tok

 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 23°C