NNPC Don Cut Petrol Price to N865

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Nigerian National Petroleum Company (NNPC) Limited don reduce the price wey dem dey sell petrol for pump. For Abuja now, dem dey sell one litre for N895, and for Lagos, e don drop to N865.

We hear say say NNPC filling stations for Abuja don reduce the price from N910 per litre go down to N895 — na N15 dem comot.

For Kubwa side of Abuja, NNPC station dey sell am sharp-sharp for N895 per litre.

For Lagos, NNPC stations don also reduce the price go N865, as e drop from the old price of N885 — na N20 dem slash for there. For example, for their station wey dey Igando road, dem don adjust the pump price to N865.

This move dey happen as competition dey hot between NNPC and Dangote Petroleum Refinery for the fuel market. Just last week, on July 8, Dangote Refinery reduce their own ex-depot price of petrol from N840 go down to N820 per litre.

Fuel price matter don dey turn real wahala, but e be like say competition dey begin benefit Nigerians small-small.


Abuja Weather

  • Abuja

    Light rain

    High: 25°C | Low: 19°C