World Bank Don Give FG $800m To Share for Naija Pipu

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

The Federal Government Of Nigeria don collect $800 million for World Bank hand wey dem go share for naija pipu after dem commot the fuel subsidy, so that pipu go fit cope with the hardship wey e go cause.

The minister of finance, budget and national planning, Zainab Ahmed, na eim tok this one wen she dey follow tori pipu tok for inside Abuja, on Wednesday, April 5.

She tok say dem go give the money to the pipu wey this mata of subsidy wey dem dey commot go affect pass, and dem don register dia name for National Social Register.

The National Social Register get 10 million families inside and that one na about 50 million Nigerians name wey dey for the register.

Madam Ahmed still yarn say no be only just to send money to pipu only o, dem still dey look for pipu wey dey do transport business to join body with dem, so that dem go fit help people wey dey work.

The Minister also tok say dem don already collect the money for  World Bank hand, and dem go try to carry everi-body follow bodi for the mata. 

Dem also dey carry the Presidential Transition Council (PTC) of Presido-Elect Bola Tinubu follow bodi for this mata, as na dem go dey power wen the fuel subsidy go end inside June this year.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 24°C