Why INEC shift PVC collection for de second time

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

DE decision of de independent national electoral commission (INEC) to shift de collection of de permanent voters card (PVC) by pipo way don register may be bcus of de push wey stakeholders push dem on de commission to give niger pipo enough time to collect dia PVCs.

Eim supposed end for sunday, January 22, but dem first shift am to sunday, January 29, for collection of PVCs for de local government offices of de commission. But after a meeting for de commission for de weekend, INEC put anoda one week join, talk say na becus of how de niger pipo dey collect dia PVC na eim make dem shift am to encouraged dem.

As eim de talk to Resident Electoral Commissioners (RECs) last friday, INEC Chairman, Prof. Mahmood Yakubu, talk say out of de 940,200 PVC sent to Lagos state, na 839,720 dem collect for de closs businesss, for dat Thursday, January 26,2023.

As eim dey talk say dem get issues wey commission suppose deal with before de general election, de INEC Chairman talk say, dem encouraged de commission by de determination of Niger pipo to collect dia PVCs.

Eim talk:" de commission is encouraged by de determination for registered voters for de whole world to collect dia PVCs.

" For example, for Lagos State, wey have de highest number of registered voters for de country,de commission delivered 940,200 for de recent voters registeration exercise( june 2021 to july 2022) for pipo wey just register and ask for transfer and pipo Wey wan replace dia cards.

"For Thursday, January 26,2023, dem don collect total of 839,720 PVCs, Wey represent 89.3 percent for de total figure.

"Dis meeting with RECs go consider reports from other states wey dey federation and de commission no go tey to do anoda thing wey go make all citizens get plenty opportunity to collect dia PVCs before de general election.

" we wan make Niger pipo no say de commission go always answer to de needs of de electorate,"eim talk.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 23°C