Uk Court No Gree Give Ekweremadu Bail

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Di Central Criminal Court for London no gree make dem bail former Deputy President of di Senate Ike Ekweremadu for di second time wey dey dey try.

For di pre-trial hearing wey dem do on Tuesday, di Old Bailey no gree give Oga Ekweremadu bail because dem feel say him go run cummot if dem gree even though him Lawyer tok say him no go run.

Punch tok say di court also tok about di matter wey Ekweremadu get with Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).
Di prosecution also tok say Ekweremadu get plenty passport and him fit run go another country wey no be Nigeria.
Di former senator lawyer tok say plenty respected people and organizations dey wey go stand for am say him no fit run and him fit deposist almost half a million pounds sterling to grant am bail and also show say him no go run.
Di Judge no still gree give am di bail, as him tok say e no make sense since di trial go soon start in like a month time.
Di trial go start on di 31st of January 2023.
Dem tok say Senator Ekweremadu and him wife been plan traffic one man wey no get house from Lagos to London to commot him kidney give deir daughter wey no well for United Kingdom.
Dem don bail Ewkeremadu wife for July and she dey UK since den.

How u see di mata? #chookmouth


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 22°C