On Air Now

Area Mata

Noon - 3:00pm

Two EKEDC Staff Don Shock Kpai

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Two Ad-Hoc staff of Eko Electricity Distribution Company(EKEDC) shock kpai for wen dem dey work.

EKEDC don loss two of dia staff on Saturday wen dem dey try fix one cable wey dey inside ground for Obalende Area for Lagos. 

Di Lagos State Police Command Public Relations officer, David Hundeyin bin confirm dis one.

Tok tok pipo confirm say one of the men wey be 51- year-old wey him name na Umaru bin first shock wen him dey dig ground to find di cable wey get issue den him second, Sunday Awaruwa wey be 48-year-old bin dey try help Umaru, na so him take shock, na so two of dem take die.

For dis mata,David Hundeyin tok say dem still dey do investigat as dem don carry dia bodi go IDH Morgue wey dey Yaba for autopsy

How una see di mata?
#chookmouth     


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C