On Air Now

Area Mata

Noon - 3:00pm

Two Don Die inside Lagos Church Stampede

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

The police command inside Lagos, tok say at least two persons don die after stampede by worshippers for the Comfort Life Mission International Church, Lagos on Thursday.

The spokesperson for the command, SP Benjamin Hundeyin tok dis one when him speak with the News Agency of Nigeria (NAN) on Friday inside Lagos.

Him tok say the wahala happen by 11.00 a.m. on Thursday, for church, wey dey for 13/15, Ewenla Street, Pab Bus stop, Ikotun, Lagos.

“The police receive report say stampede happen for dia congregational service inside church on Thursday.

“Because of the stampede, five pipu don slump and dey rush dem go Isolo General Hospital, for treatment.


“Woman of about 45 years old and one 5-year-old girl die but dem neva  know dia identities.


“The dead body dey Mainland General Hospital mortuary, Yaba, for preservation, investigation still dey in progress,” na wetin him tok. (NAN) 

 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C