Tinubu Na The Best Person For The Work- Buhari Tell Nigeria

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

President Muhammadu Buhari don tell the winner of the 2023 presido election, Bola Ahmed Tinubu congratulobia for eim win.

Presido Buhari tok say Tinubu na the best man for the work of presido, naim make pipu don vote am as presido. eim still tok say eim go work with Tinubu team to make sure say everi-everi go seriri-werere.

Eim say the election show say democracy still dey work for inside Africa, with all the military coups wey dey happen inside Africa. With the way everi-everi take go for the election e mean say our democracy do ripe.

Buhari still tok say abi we see say eim party no win for eim state, this one show say things don change for our politics, because where some party dey win before, them no fit win am inside this election, and this one dey good for our democracy.

The Presido come say eim believe say the result of the election show say na Tinubu pipu want. But eim know say some politician no go gree with this one wey eim tok so if anybodi believe say any mago-mago dey the result make dem  carry the prove go court. 

Oga Buhari still tell all the candidates make dem no foget say dem sign peace accord, so make dem no do anything wey go cause gbege.

Bola Tinubu win 12 states and eim get eight million, seven hundred and ninety-four thousand, seven hundred and twenty-six (8,805,655) Votes.

Alhaji Atiku Abubakar of the Peoples Democratic Party carry second as eim too win for 12 states with total of six million, nine hundred and eighty four thousand, five hundred and twenty (6,984,520) votes. And Mr Peter Obi of the Labour Party carry third with six million, one hundred and one thousand, five hundred and thirty-three (6,098,588) Votes

Dr Rabiu Musa Kwankwaso of the New Nigeria People's Party, NNNPP carry fourth position with one million, four hundred and ninety-six thousand, six hundred and eighty-seven (1,496,687) votes.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 23°C