On Air Now

Evening Oyoyo

7:00pm - 11:00pm

Tinubu Approve 15% Import Duty on top Petrol and Diesel

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

President Bola Ahmed Tinubu don approve 15% import duty on petrol and automotive diesel.

For dis new move wey government say go help protect local refinery capacity, di president approve di increase as part of plans to stabilise di downstream sector after many years of plenty importation.

Di directive dey inside letter wey dem send go Federal Inland Revenue Service (FIRS) and Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority.

Di letter bin carry di signature of di president private secretary, Damilotun Aderemi, on 21 October.

Government talk say di duty go apply to di cost, insurance and freight (CIF) value of any imported fuel.

Di levy fit increase di landing cost of imported petrol by about ₦100 to ₦175 for one litre, depending on exchange rate and shipping cost.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 30°C | Low: 20°C