The Train Wey We Go Use For The Red Line Don Land.

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Lagos state government don come out come yarn on top dia social media page say the train wey go ride on top the red line don land for Lagos.

Lagos State commissioner of information and strategy, Gbenga Omotosho come tok say the TALGO series 8 train wey dem buy from Milwaukee, don Lagos. 

Dem also tok say the train go fit carry 1500 people for inside at once. As e get up to 21 coach wey people fit siddon inside. 

The engineers for the company wey dem buy the train also dey to help arrange the train together. 

If you remember say Lagos state government  tok before say the Red Line train route wey go from Agbado come reach Marina, go dey ready before the first three months inside 2023. 

But shey this one go fit solve the traffic wahala for Lagos na only time go tell.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 23°C