Supreme Court Go Judge PDP Case Against Tinubu, Shettima for May 26

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Di Supreme Court On May 26 go judge di case of Peoples Democratic Party, PDP, wey dem put on top President- elect, Sen. Bola Tinubu and him Vice-President elect.

PDP carry appeal go Supreme Court say make dem change wetin Court of Appeal rule say di party no get legal standing (locus standi) to pursue di case and na Justice James Abundaga led dis one.

Supreme Court go give dia Judgement three days to di swearing in of President elect and Vice- President elect. 

PDP don file dis case since July 28, 2022 and dis case dey tok say Shettima's nomination as Tinubu running mate no follow wetin dey inside di Electoral Act, 2022.

PDP still tok say Shettima no suppose dey try get Vice president nomination an borno Central senetorial seat as e don dey breach di law.

How una see di mata?
#chookmouth  


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 23°C