On Air Now

Area Mata

Noon - 3:00pm

Supreme Court Don Dismiss PDP Case Against Kashim Shettima

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Di Supreme Court don dismiss case wey PDP dem tok say President- elect Bola Tinubu and eim Vice President- elect Kashim Shettima no qualify.

Di five member panel of di supreme court meet on Friday to tok say PDP no get ground to carry dis case. 

Na Judge Adamu Jauro read di judgement of di Supreme Court wey tok say PDP  bin carry mata wey no concern dem as dem no be member of APC.

court still tok say di case no get evidence as Kashim Shettima bin withdraw im nomination as Senator for borno Central Senatorial district.

PDP bin dey tok say Shettima's nomination as Tinubu's running mate bin no follow di law wey dey sections 29(1), 33, 35 and 84(1)(2) of di Electoral Act, 2022.

 
How una see di mata?
#chookmouth  


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 23°C