On Air Now

Area Mata

Noon - 3:00pm

Shame No Dey Catch You? Dino Melaye ask Wike

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

E come be like say The Peoples Democratic Party, PDP, don finally tire for Rivers State Governor, Nyesom Wike mata as dem don drop statement wey dem use take para for wetin the Governor yarn about dia presido flag man.

No be news say Governor Wike don dey tok say the only way wey eim fit support the party presido candidate na if the PDP national Chairman, Iyorchia Ayu commot for the chair as chairmo of the party.

Oga Wike still tok say something dey wrong with oga Atiku as because of say Former presido Olusegun Obasanjo, give eim support to  Labour Party Peter Obi presido flag man.

This one make the tok tok person and Director Public Affairs PDP Presidential Campaign Management Committee, Senator Dino Melaye, yarn say shame suppose dey catch oga Wike for wetin eim dey tok.

According to Meleye, " Wike suppose dey shame as eim don dey find Oga Atiku face with all the things wey eim don dey tok since, plus the insult wey eim dey give Atiku wey no do am anything.

Dino come say instead of to dey tok make Governor Wike support any who eim wan support, because dem no go take all this film wey eim dey act again.  after all shebi if some to dey worry am abi Former Governor of Rivers state Rotimi Amaechi for  hand over to am.
 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C