Seven Pipo Don Die For Di Calabar Carnival Accident

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Federal Road Safety Corps (FRSC) don confirm say na seven pipo na im die for di accident wey happen for Calabar Carnival on Tuesday.

Twenty-nine pipo and five children na im wound.

Di Sector Commander of di Corps , Maikano Hassan tok say di accident happen for front of Jumat Mosque when di Bikers dey do deir Parade.

People wey dey there when e happen say one sedan motor loose control, come go jam people wey dey dey look di Carnival on di fifth day of di carnival wey dem dey do every year.

Governor Ben Ayade of Cross River don show say this matter pain am no be small and him don order security pipo to arrest di driver of di motor.

He also tok say make Bikers pipo no do their Parade again to honor di pipo wey die and wound for di accident.

#chookmouth


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 22°C