On Air Now

Area Mata

Noon - 3:00pm

Senator Dino Melaye Don Kolobi PDP Governorship Ticket

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Dino Melaye, wey be former senator, of Kogi West Senatorial District, don win the Peoples Democratic Party (PDP) governorship primary election for inside Kogi.

Melaye use 313 votes take kolobi the ticket and the person wey follow am drag the ticket Idoko Ilonah, get 124 votes for inside the direct method primary wey dem do for inside the state capital of Lokoja.

The chairmo of the PDP Primary Election Committee, Alhaji Ahmed Makarfi, na eim come tok the result, and eim say everi-everi for the election go wella without any wahala.

Maikarfi also yarn say other pipu wey follow join bodi to drag for the Governorship ticket for the party na Mohammed Kabiru wey get 121 votes, Abayomi Awoniyi-Sunday wey get 77 votes, Wada Musa wey get 56 vote, Ojaja Gideon-Enama wey get 5 votes and Olufemi Olarewaju wey get 2 votes.

Out of all the void wey dey get for the primaries na only 6 votes dey invalid.
 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 32°C | Low: 22°C