Senate go Hold Dia Valedictory Session on Saturday

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Di Senate go hold eim valedictory session on Saturday, wey go mark di end of di ninth Assembly.

Senate Presido, Ahmed Lawan announce dis one on Wednesday.

Oga Lawan tok say dem quick announce dis one so di pipo wey dey make law go get plenti time to prepare dia presentations of all di tins wey dem do for di last four years.

He still tok say President Bola Tinubu go meet all di Senators-elect and Representatives-elect on Thursday.

Sentaor Lawan thank di Senate tok tok join bodi for di correct work wey dem do for di past four years for di National Assembly.

How una see di mata?
#chookmouth


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C