Senate Don Approve 20 Special Advisers for Tinubu.

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Di Senate don approve President Bola Tinubu request to appoint 20 Special Advisers.

Tinubu bin put dis reqquest for di letter wey di Presido of di Senate, Ahmed Lawan bin read on Tuesday.

Afta dem don read di letter, one senate leader Ibrahim Gobir bin move motion say make dem consider and approve di Presido request.

Di Senate come quick look di request and approve am sharp sharp.

How una see di mata?
#chookmouth 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C