Second Niger Bridge : Di King of Obosi Don Hail FG

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

King of Obosi and di Prince of Oba dey praise Federal Government and dem dey also ginger FG to come finish di bridge.

Di Prince of Oba community for Idemili South Local Government Area wey dey for Anambra State, Prince Noel Ezenwa, and di king of Obosi community for Idemili North Local Government Area wey dey for Anambra State, Igwe Chidubem Iweka III, don praise di Federal Government for di Second Niger Bridge.

Di two royal pipo praise Federal Government ontop dis very important project wey Naija pipo go fit enjoy di Second Niger Bridge to dey pass enter di two communities.

Prince Ezenwa wey tok to journalists for Oba, on Wednesday, dey ginger di government to make sure say dey finish di bridge sharp sharp with everything wey dem say dem go do for di bridge.

Meanwhile, di Obosi King, Igwe Chidubem Iweka III, don give chieftaincy to one of di foreign engineers wey dey handle di project, say dem make am proud for di project.

He tok say,''Him and di Obosi community dey impressed about di bridge and di community come decide to give di chieftaincy title of Agu Simba (Lion from another land) to di project manager of Julius Berger Limited, di contractor wey dey handle di project, Mr Frederick Weisser, when we dey do our yearly Obiora cultural festival, dis one mean say Weisser don be part of di Obosi royal cabinet''.

How u see di mata? #chookmouth


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 23°C