Police For Ogun State Don Carry Portable Enta Court

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

The Nigerian police force for inside Ogun state don carry "Zazu Zeh" singer Portable enta High Court for inside Ifo on Monday morning.


Habeeb Okikiola wey many pipu know as Portable go answer the question ontop the six count wey dem tok say eim gbege pipu anyhow.

If you remember say Police been try to arrest the singer on thursday but eim follow dem do gra-gra say dem no fit arrest am. But eim come go the station on friday.

 

Tok-Tok person of Ogun State Police Command, Muyiwa Adejobi tok say the singer get six charge wey dey ontop eim head, and for inside that six mata, the gra-gra wey eim do with policemen wey come arrest am no dey inside.

Adejobi still tok say man know man no dey for inside law, so portable go answer all the mata wey dem don pot for eim head.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 23°C