Police Don Arrest Two Wayowayo 419 Boys

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Police don arrest two pipo wey dem tok say dey use computer take do 419, wey dey pretend to be another pipo and dem dey also do cryptocurrency fraud dey use take thief money from people.

Di two pipo wey dem arrest na Odia Theophilus (24) and Ebo Junior Success (25), dey do international internet fraud, dem dey pretend to be another person dey go come dey promise their victims relationship take dey dupe dem.

Police pipo Public Relation's Officer, Olumuyiwa Adejobi, tok say di force receive information from di police pipo wey dey for South Korea and dem tok say di suspects scam their citizen wey be Baek Seong-hee- of 259,637,941 Korean Won (KRW) for cryptocurrency wey go be N91 million, if dem change am to Nigeria money.

 Dem pretend say dem be member of di US Army wey dem send go Yemen and dem come pretend say dem dey do romantic relationship with di victim before dem come dupe am, dem dey follow di victim dey tok for one mobile messaging application wey dem dey call Kakaotalk.

Investigations wey Police National Cybercrime Centre do na im lead to di arrest of Theophilus and Success for Benin City, Edo State.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 22°C