Police arrest Ice Prince sake of say he beat police officer

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?
Dem arrest Ice Prince early today Friday 2nd September,2022. Na Police Public Relations Officer, Benjamin Hundeyin tok dis one.

Lagos State Police Command don arrest popular musician, Ice Prince, sake of say he beat police officer.

Hundeyin tok for twitter say, “At 3am today, we stop Ice Prince bcos he dey drive without plate number, and he agree make we take am go station. 

“He beat police officer wey enta eim car, nd say he go throw di police officer for river. We don arrest am and e dey go court today.”


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C