On Air Now

Area Mata

Noon - 3:00pm

Pikin Kill Eim Papa Becos Of Say Eim Dey Use Jazz For Am

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Police for inside Akwa Ibom State Command don tok say dem don hold one Joseph Friday becos eim killing eim papa because eim feel say eim Papa dey use jazz for am.

The suspect yarns eim papa dey show for eim dream wen eim sleep come dey jazz am, naim make eim beat am to death.

Friday beat eim papa, Friday Wilson Usanga wey dey 65 yrs old. Come kill am come carry the dead body of eim papa enter street come dey tok say naim eim kill am.

When dey ask Friday how eim papa take dey jazz am for dream, eim tok say for eim dream eim dey see eim papa dey put something like  tortoise inside eim body and once the tortoise enter eim body for dream eim go dey do like person wey no well for head.

Commissioner of Police, Olatoye Durosinmi say na the suspect's mama, Mrs Eno Friday Wilson naim carry the mata come meet police wey make dem fit arrest her pikin.

Durosinmi come tok say the police officers wey dey Nsit Ibom Division, for Nsit Ibom LGA, Akwa Ibom. Don Arrest 25 years Joseph Friday wey tok say eim be farmer.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 23°C