On Air Now

Evening Oyoyo

7:00pm - 11:00pm

Two Men Don Land For Kirikiri Ontop Rape Mata

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

50-year-old man rape eim neighbor 12 -year-old daughter and 24- year -old man rape 6-year -old

One Henry Okeke don land himself for Kirikiri Prison becos eim rape with small pikin of 12 years old for Fola Agoro, Somolu area of Lagos State.

Magistarte patrick Nwaka make dis order after dis Henry wey get two count of rape for eim head stand for court. 

Di police representative, Thomas Narudeen tell court say di 50 year old man bin rape ndi girl wen she come back from message wey eim send her.

Still ontop dis rape mata, one 24 year old Islamic teacher , Mosedi Toheeb don dey tok everything wey him know as he don land  for prison after one Yaba Chief Magistrates' Court don send am go prison sake of say him get two counts of sexual violation for him head as him rape one six year old for University of Lagos central Mosque

Dem don shift di two case go June 19, 2023.

How una see di mata?
#chookmouth  


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C