No Campaign For Lekki Toll Gate For Oct 1 - Court Tell Peter Obi & Supporters

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Federal high court judge inside Lagos don draw hand for ear tok say make Labour Party and dia supporters no carry dem self go do any rally for Lekki toll gate on 1st of October.

Justice Daniel Osiagor come even tell the Inspector General of Police(IGP), Usman Baba, and the Lagos State Police Commissioner, Abiodun Alabi say as eim don tok this one make dem make sure say na like so e be that day.

The court tok this one because 10  pipu the case wey 10 pipu bring come make the court stop Labour Party presidential candidate Peter Obi, his running mate Datti Baba-Ahmed, one Julius Abure and Obidient followers make dem no do rally.

Naim make Justice Osiagor chook eye for the case come tok for the mata say, make the Obidient supporters no stay for lekki toll gate do dia rally but dem dey free to waka pass the toll gate come follow Falomo Bridge
 any other location.
 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C