Nigerians Don Get Hope as Di Largest Single Train Refinery For Di World Don Open For Naija

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Di Largest Single Train Refinery For Di world Go Start Work For Lagos.

Di largest single train refinery for di world na Dangote Refinery don start work for Lagos, Nigeria. Na 650,000 barrel per day dis refinery go dey produce .

Presido Buhari come Lagos yesterday, Monday come cut di rope of di refinery. Our Presido tok say dis one wey don happen na big achieve for di economy for Naija. Him still tok say dis one na game changer for all the mata wey concern di petrol market for di full Africa region.

Di products wey go dey come out from di refinery go start to spread from July or August dis year. 

Di Oga of Dangote group, Aliko Dangote tok say dis refinery go move dii economy for Naija from di largest importer to di largest  exporter

Dem design Dangote refinery to fit process crude oil from three continents; Africa, Asia and America. E go produce 650,000 barrels per day. Di refinery go deliver about 38 million litres of petrol, diesel, kerosene and fuel for aeroplane for Naija everyday. E go still create 100,000 direct and indirect jobs and still provide $21 billion for Naija every year.

How una see di mata?
#chookmouth   

       


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 23°C