On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 5:00am

Nigeria Info Lagos Don Win Award For Best Radio Station of Di Year For Naija

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Nigeria Info Lagos don carry di award for best radio station of di year for di first Nigeria Broadcasting Awards wey happen on Wednesday night for Lagos.

Our sister station Nigeria Info Lagos carry three of di awards wey be Best Radio Production in Documentary and Feature and Nigeria Info Port Harcourt win Best Radio Station for News. Dis award be di first edition of di Broadcasting Association of Nigeria 

Nigeria Info's Programs Manager Sheriff Quadry na im go collect di awards dem, as e collect am, e tok say dis awards dem show say dem dey do di work to make sure say na correct news and information dem dey carry give dia listeners.

Sheriff still tok say make listeners no comot dia ear because more beta beta go show for dia station. 

Nigeria Info bin get eleven nominations and di competition tight well well and dem still see three of di awards  carry go house.   
 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C