On Air Now

Evening Oyoyo

7:00pm - 11:00pm

Nigeria buy N1.4 billion moto, to take help Niger Republic fight insecurity

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

On tuesday one tori pesin David Hundeyin, post document wey show say we federal government sign N1.4 billion to take buy moto for the government of Niger Republic.

This one come make tori pipu  wey dey for ASO rock on wednesday, come dey ask Minister of Finance, Budget and National Planning, Zainab Ahmed, after she come out from  Federal Executive Council with President Buhari.

 

If na true say the obodo naija spend N1.4 billion to take  buy moto for the government of Niger Republic, and why we dey buy moto for anoda country.

She tok say the document na true, say Federal Government don sign say make dem use N1.4billion take arrange moto for Niger Republic. The moto na for Niger Republic to use am take fight insecurity wey dey shele for there.

According to Madam Ahmed, yarn. She say no be first time wey Nigeria go dey support our neighbour on top mata of insecurity and na Oga Presido Muhammadu Buhari say e go good make dem buy this one to ginger the fight wey dem dey fight insecurity for that area.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C