On Air Now

Area Mata

Noon - 3:00pm

Niger State Governor Don Call Curfew As Dem Kill Village Head

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Abubakar Sani Bello wey be Governor of Niger State don order time wey di pipo of di Lambata Gurara Local Government Area for di state go fit dey open, close, or even go outside after one big fight wey happen wey dem kill di village head wey be Mohammed Abdulsafur.

For di tok wey di State Government Secretary, Ahmed Matane, give on Sunday for Minna wey be di capital of Niger State, he tok say, when some bad boys dey fight one big fight for Saturday, na im dem kill di village head of Lambata.

Governor Bello tell di town say starting from Sunday, pipo fit come out of deir house by 6am but dem must go inside by 6pm till dem settle di whole matter. 

He tok say dis time wey him give di pipo to dey come out and go back to deir house, na to help security pipo to fit control di situation, save lives and bring back law and order for di community. 

As di Governor tok, di government beat hand for deir chest say dem no dey in support of di violence, fight and act of lawlessness wey happen for Lambata town.

He dey beg di pipo of di community to help di security pipo bring back peace to di town and he dey ginger security pipo to make sure say di pipo obey di time wey dem suppose go outside and come inside.

#chookmouth

 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C