On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 6:00am

NDLEA Don Warn Skit Makers Make Dem no Dey Use Dia Logo, Jackets

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Di National Drug Law Enforcement Agency, (NDLEA), don warn skit makers to stop to dey use dia logo and jackets in dia production.

Dis warning bin dey for one statement wey di NDLEA Director of Media and Advocacy Mr Femi Babafemi, on Tuesday for Abuja. 

Babafemi warn dem wey sabi use the jackets of NDLEA to mislead pipo say make dem ready face the gbege wey go land dem. 

Him bin dey react to one video of some pipo wey wear red jackets wey be like di one wey di officers and men of di agency bin dey use one year ago. 

Di spokesman tok say di agency bin don drop one correct statement for May 21, 2022 wey tok say di video na skit wey one MAthew C Eze wey de live for Lekki, Lagos. 

"One year don pass and di video don show again for social media and dis one don cause plenty tok tok of weda di video na true or lie.

Di spokesman still tok say, "We go still tok am again say make skit makers be careful with di content wey dem dey drop.

"Also, dem go need to behave well with how dem dey use tins wey concern law enforcement officers so dem go dey mislead people ". (NAN)


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 24°C