On Air Now

Evening Oyoyo

7:00pm - 11:00pm

NAFDAC Talk Say Local Drug Production Don Increase for Naija

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Kaduna State Governor Uba Sani don visit Kurmin Wali community for Kajuru Local Government Area after gunmen kidnap villagers. Security agencies don confirm say at least 11 victims don escape from captivity and don return house safely.

NAFDAC Talk Say Local Drug Production Don Increase for Naija

NAFDAC don talk say local production of drugs and medical devices don rise well-well after new rules wey dem bring to boost made-in-Nigeria manufacturing.

Di agency Director-General, Prof. Mojisola Adeyeye, say by October 2025, NAFDAC don approve 161 factory layout submissions. Dis cover 96 new companies and 65 old ones, plus six medical device manufacturers.

She explain say policies like di 5+5 Regulatory Directive and di Ceiling List don help reserve plenty products for local production. According to her, over 70% of these drugs now dey made inside Nigeria.

Adeyeye add say di import-to-local production ratio don improve from 70:30 for 2019 to 60:40 for 2025, show say local capacity dey grow.

On enforcement, NAFDAC say dem make 114 arrests last year and don change strategy to risk-based and intelligence-driven approach, wey dey follow global best practice.

She talk say all these reforms na to push self-sufficiency, protect public health, and reduce Nigeria dependence on imported drugs and medical devices.

 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 33°C | Low: 22°C