On Air Now

Area Mata

Noon - 3:00pm

“Na President I Wan Be for 2027, No Be Atiku Running Mate”- Peter Obi

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Former Anambra State Governor and Labour Party 2023 presidential candidate, Peter Obi, don finally open up say him go run for Nigeria presidency again come 2027, and say all di talk wey dey fly around say him wan be Atiku Abubakar running mate no follow at all.

Obi yarn dis one for inside one interview wey air for Channels Television Sunday Politics on Sunday night. As dem ask am straight whether e go contest, Peter Obi no waste time:

“I’m going to contest for the President of the Federal Republic of Nigeria, and I believe I am qualified for it.”

Rumour say Obi and Atiku fit run together under one coalition, but Obi shut that talk down gbagam:

“This is not in play; nobody has ever discussed that. People assume so many things. Nobody has ever discussed with me whether I am going to be A or B or C.”

Obi also confirm say him still dey solid for inside Labour Party, but him dey work with other parties like ADC (African Democratic Congress) to build strong opposition coalition wey go shake table wella and fit remove President Bola Tinubu from seat come 2027.

“I am part of the coalition which will be able to produce a president with the capacity and compassion to save this country,” Obi talk.

As di 2027 election dey draw near, e clear say Obi no dey joke – him eye dey ground, him target na Aso Rock, and him message na clear: Na to lead Nigeria, no be to follow anybody.


Abuja Weather

  • Abuja

    Thunder storm

    High: 25°C | Low: 20°C