My Daughter Bin Get Belle with Twins - Raheem Mama

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

The mama of Omobolanle Raheem wey police pipo kill on Christmas day tok say di lawyer bin get belle of twins.

TheCable na im confirm say on Tuesday wey di state Commissioner of Police, Abiodun Alabi go visit to show di family him support na when her mama tok this one.

''I no fit see my 'The Law' again,'' di mama tok.

Pipo dey always call her 'The Law'. Dem don collect am from my hand. She get belle with twins.

She don die with her glory. She leave her five-years-old daughter go. And dem carry her.

Di mama tok say she bin sell orange for street to take support Raheem go school.

Assistant Superintendent of Police, Drambi Vandi, na im shoot di lawyer wey dey handle properties as she dey come back from church service for Ajah, Lagos.

Police Pipo don catch Vandi and dem go carry am go court.

#chookmouth


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 22°C