LAWMA Go Begin Close House Wey No Get Waste Bucket For Lagos

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

If your house no get waste bucket for Lagos, dis news na for you.

Lagos Waste Management Authority don plan to start operation lock any house wey no get waste buckets for Lagos Island and Mainland starting from July 7.

Di Executive Director, Finance of LAWMA, wey im name na Kunle Adebiyi, say dem don already tell pipo make dem go buy container wey dem go put dia dirty so dat dem no go throway dirty anyhow, because na rainy season we dey.

LAWMA tok say dem don give enough time to pipo make dem get  waste buckets.

How u see dis mata?
#chookmouth


Abuja Weather

  • Abuja

    Thundery shower

    High: 32°C | Low: 22°C