Lagos Go Arrest Pesin Wey Do Wayo Call For Fire Office

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

The Lagos State Government go arrest one Uzuokwu Solomon bcos im do wayo call to di people wey dey answer emergency

Deputy Director of Public Affairs,Ololade Abgoola for the Lagos State Fire and Rescue Service tok dis one for one statement wey dem release on Tuesday night.

Solomon wey be 18 years old go call di Fire Service emergency line on Friday, April 14,2023 by 5:35 pm from Harmony Estate for Ajah area for Lagos say fire emergency don dey for inside the estate.Na so di Lekki Phase II Fire Service carry waka  with fire trucks to go quench di fire, as dem reach there dem no see any fire for di estate. Dis type of wayo calls don dey happen before for the estate, na di estate security join hand with di fire serevice people to find di people wey dey do this badness and na im lead to the arrest of the person.

Dis badness wey solomon commit so dey punishable under the Lagos State Fire Service Law and Command and Control Centre Law of 2013. Di court waka for this case go happen for Ogba Magistrate Court for April 19, 2023 by 9:00 am.

Di Director of di Lagos State Fire and Rescue Service, Mrs. Magaret Adeseye come tok say she happy well well as dem fit catch one of the culprits. Mrs. Adeseye tok say she believe say di arrest wey happen go be warning to oda pipo wey dey do dis type of badness 

Ololade tok say dem don dey do dis wayo emergency calls for di past six months and say na mater wey Government need to chook eye put well well.     
 

How u see di mata? #chookmouth


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C